Central African Republic vs Ghana preview: Kudus, Semenyo, Partey fit lead Blackstars to 2026 World Cup dream?

Wia dis foto come from, JARED TILTON VIA GETTY/PATRICK SMITH/GETTY
Wetin we call dis foto, Ghana fit take one step close to di 2026 World Cup if dem win dia game against Central African Republic; dem go seal qualification if dem win and Madagascar and Comoros drop points8 October 2025, 10:58 WAT
New Informate 2 minutes wey don pass
Time reach for dis crucial World Cup qualifier between Central African Republic and Ghana.
Plenti tins dey at stake for Ghana wey wan qualify for di mundial since dem fail to qualify for di 2025 Africa cup of nations.
Coach Otto Addo say di team learn from dia mistakes in di match against Chad wey make dem get late equalizer to finish dat game 1-1 for D’jamena.
Di Blackstars go hope to seal qualification and carry one leg enta di World Cup wit dis win sake of Central African Republic already get zero chance to qualify wit dia five points from eight games.
Both teams drop lineup for dis game.
Asare (GK); Djiku, Salisu, Mensah, Yirenyi, Sibo, Partey, Kudus, Jordan, Fatawu, Semenyo
Background
Di Blackstars of Ghana afta dia 1-0 win against Mali for di last qualifiers dey hope to go one step closer to di 2026 World Cup wit dia final away game against Central African Republic on Wednesday 8 October.
Alexander Djiku score di only goal for di Mali game to grab all three points for di Blackstars to keep dem at di top of Group I.
Ghana get 19 points, followed by Madagascar wit 16, Comoros get 15 and Mali dey fourth wit 12 points.
Central African Republic, di opponent of di Blackstars, get five points from eight games and Chad wey be di whipping boys for di group, get only one point, afta dem draw wit Ghana for N’Djamena.
Coach Otto Addo ahead of di game say di team learn dia lesson from di game against Chad.
Afta dat game, fans and experts put pressure for di sacking of di coach.
But Otto Addo say “as a team we for learn to hold on till di last minute wey we for fight in defence even as we go attack and create chances to score.”
“Everybody for be on dia toes till di final whistle. We for win dis game and move a step closer to di World Cup,” coach Otto Addo tok.
E also explain say “we for no tink too far, di first task be against CAR so we for focus on dat one. If we win dis one, we get high chance to qualify.”
Coach Otto Addo admit say di team dey under pressure to deliver, but “dis be normal pressure, especially as we dey lead di table wit only two points. Di players make ready to deliver especially wit an early goal, to make tins easy.”
Central African Republic no go fit qualify for di tournament – wit dia current five points but dem go try upset oda teams like Ghana, to spoil dia party.
Di last time di two teams face each oda, Raoul Savoy be dema coach.
But e now dey coach Chad.
Savoy believe say Ghana go qualify for di World Cup
“If Ghana no qualify, e go be big failure; sake of dem dey good position now.”
Savoy add say “e go be professional failure if Ghana no qualify. I tip di blackstars ova di oda teams.”
Current CAR coach Rigobert Song dey hope im team go pour sand inside di gari of di Blackstars.
Wia dis foto come from, FEDERATION CENTRAFRICAINE DE FOOTBALL
Wetin we call dis foto, CAR get only 5 points from 8 games during di qualifiers; dem fal to qualify for di World Cup but dem go try to upset di Blackstars
Team news
Coach Otto Addo get di full squad ready for dis game apart from Athletic Club captain Inaki Williams wey pull out sake of injury.
Coventry City striker Brandon Thomas – Asante replace di striker for di camp wey e fit play some part for dis game.
Thomas Asante dey in-form wit five goals and three assists for di championship so far dis season.
Key players like Tottenham Hotspurs forward Mohammed Kudus also dey good form wit one goal and four assists for his new club.
Antoine Semenyo wey be Bournemouth star player also dey available to lead di attack.
Wit six goals and three assists for Bournemouth dis season, di striker dey in form and Ghana go hope say he go translate some of dat form for dis game v CAR.
Coach Otto Addo welcome back Abdul Fatawu Issahaku to di team he miss at least six months sake of injury.
But di winger dey form wey e also score three goals for Leicester City dis season.
Villarreal midfielder Thomas Partey also dey available for di game, togeda wit captain Jordan Ayew and Real Oviedo midfielder Kwasi Sibo (who go play only for di second time for Ghana).
For Central African Republic wey lose dia last two games against Madagascar and Comoros, dis game only be for pride since dem no fit qualify for di World Cup.
Key players like Geoffery Lembet and Dominque Youfeigane as well as defender Hugo Gambor and forward Bertillon Arnold Yangana go try to put pressure on Ghana and spoil dia party.
Wia dis foto come from, GHANA FOOTBALL ASSOCIATION
Wetin we call dis foto, Ghana dey hope dia in-form players for Europe go replicate dia form for di Blackstars
Stats for both teams
CAR concede 17 goals so far in di qualifiers.
Dis be di second most goals for di group; dem also score eight goals.
Dem dey winless in eight games across all competitions ahead of dis game.
Dem go hope to finally grab a win, even though e no go still mean anything for dem failed qualification dream.
Di Blackstars dey lead di group wit 17 goals so far; di most goals for Group I.
Dem also concede six goals.
Captain Jordan Ayew be di top scorer for Ghana wit six goals during di qualifiers, di third for di goal chart after Denis Bouanga from Gabon and Mohammed Salah of Egypt.
Wia dis foto come from, GHANA FOOTBALL ASSOCIATION
Wetin we call dis foto, Ghana beat CAR 4-3 for di first leg of dis fixture for Baba Yara Stadium in Kumasi
Head-to-head
Ghana already play CAR for di 2024 Afcon qualifiers wey Blackstars win 2-1 wit goals from Kudus and Ernest Nuamah for September 2023.
For di earlier game for CAR during di Afcon qualifiers, Ghana secure 1-1 draw away.
For di first leg of dis World Cup qualifiers, Ghana beat CAR 4-3 for di Baba Yara sports stadium for Kumasi on 10 June 2024.
Captain Jordan Ayew score wey Fatawu Issahaku score one goal.
Louis Mafouta also score hattrick inside dat game but CAR lose.
CAR for di last three meetings wit Ghana no get win.
Dem lose two, wey dem draw di oda one.
Key players
Les Fauves dia record goal scorer Louis Mafouta go hope to score again wen e lead di attack afta e score three goals against Ghana for di first leg.
Di 30-year-old Guingamp player get 16 goals for CAR from 31 caps.
Im also get 24 goals from 66 appearances for im club Amiens since 2023 bifor he join Guingamp.
Venuste Baboula be anoda key player for di wild beasts.
Wit three goals in 10 games, di attacker fit cause trouble for Ghana.
At club level, e score three goals in 18 games for Bravo.
Ghana go count on dia star boys Mo Kudus, Antoine Semenyo, Jordan Ayew and Alexandre Djiku for defence to try and conquer dis game.
Possible lineups
Asare (GK); Djiku, Salisu, Mensah, Yirenyi, Sibo, Partey, Kudus, Jordan, Fatawu, Semenyo
Abimala (GK), Yangao, Gambor, Miambaye, Basse-Zokana, Beyissa, Oualengbe, Gusset, YAwanendji, Djimet, Mafouta.
Di game go happen at 4 PM GMT (5PM WAT) for di Stade d’Honneur Meknès in Meknes, Morocco.
Make you join us for live commentary for here.




