Ghana vs Comoros: Blackstars final 2026 Fifa World Cup qualify match

Wia dis foto come from, GETTY/MB MEDIA VIA GETTY IMAGES
Wetin we call dis foto, Ghana only need one point to confam dia place for di world cup, but Comoros dey hope to spoil dia party12 October 2025, 13:28 WAT
New Informate 4 minutes wey don pass
Few minutes bifor di game between Ghana and Comoros for Accra.
Ghana get one leg for di World Cup, dem dey need only one point to seal di deal.
Dem go still qualify if dem lose wey Madagascar win.
For Madagascar to win di group, dem for score at least eight or more goals vs Mali to beat Ghana on goal difference.
If dem still tie wit goal difference, then dem go look at di number of goals both teams score.
Ghana dey enta dis game wit 22 goals against 16 for Madagascar.
Di two coaches release dia lineup for di game.
Ghana XI: Asare (GK), Alidu Seidu, Jonas Adjetey, Mohammed Salisu, Ebenezer Anan, Kwasi Sibo, Thomas Partey, Antoine Semenyo, Mohammed Kudus, Jordan Ayew
Build up
Di Blackstars get one foot already for di 2026 World Cup but dem go finally confam dia place if dem get at least a draw from di final Group I qualifier vs Comoros on Sunday.
Ghana dey enter dis game wit full vim afta dem scatter Central African Republic 5-0 for Morocco last week.
Goals from five different players – two defenders – Mohammed Salisu and Alexander Djiku as well as Captain Jordan Ayew, Thomas Partey and substitute Kamaldeen Sulemana seal di three points afta di dominant display.
Wit dis result – Ghana get 22 points at di top of Group I, Madagascar wey win dem game 2-1 vs Comoros dey second wit 19 points.
Mali beat Chad 2-0 to dey on di same points (15) wit Comoros.
Ghana go hope to seal dia fate v Comoros for for Accra, wey Madagascar go take on Mali.
Three teams dey fight to finish second for dis group.
Chad go play wit Central African Republic wey Mali go play wit Madagascar.
All di three matches go happun at di same time.
If Ghana lose wey Madagascar win dia game, dem go dey level om 22 points wit Ghana.
Wia dis foto come from, DANIEL BELOUMOU OLOMO AFP VIA GETTY
Wetin we call dis foto, Comoros beat Ghana 1-0 for di first leg of di World Cup qualifiers in 2023
Wetin di coaches tok
Ghana lose to Comoros (1-0) for di first leg of di group I qualifier on 21 November 2023.
Dat be di only defeat di Blackstars suffer for di qualifiers, wey dem go hope to avenge dat defeat for dis game wey go happun for di Accra sports stadium.
Ghana coach Otto Addo warn di players against ‘complacency’.
“We get di same mentality for all our games – we wan end dis qualification wit victory. Sometimes in dis game of football, you comot your eye, you fit lose. My team in di past lose one game we dey lead 4-0. Dat game end 6-4, so we for be very careful “
E add say “we want do dis one for di fans wey dey support us throughout di qualification.”
Coach Otto Addo say “we show di players plenti clips of wetin we wan do wey we dey enta dis game wit 100 percent focus.”
But di former Dortmund player scout know say tins no go be easy against di “Les Coelacantes”.
“Comoros be really good team wey dem play some good football ova di last years, so e never go be easy.”
“Even though dem lose to Mali (3-0) and Madagascar (2-1), dem create plenty chances inside those games, but wit di right mentality we fit beat dem.
If Otto Addo fit qualify for dis World Cup, he go become di only coach to carry Ghana go di world cup two times.
Wia dis foto come from, FFC
Wetin we call dis foto, Comoros coach admit say di Ghana team dem beat for 2023 no be di same team dem go face on Sunday
But Otto Addo no wan rock di boat just yet.
“I no dey tink about dat record serf, e never be about me, but di team. All I dey tink about be how to qualify for di Mundial.”
Comoros team coach Stefano Cusin say dem make ready for an upset for dis game.
“We lose di last game v Madagascar, so di team learn from dat game, from di time we beat Ghana for di first round in 2023 till now be long time, many tins change now.”
E also explain say “Ghana get good players, wey dem dey play at home, dem almost qualify, so of course everitin dey go on well for di team, but we go try our best.”
Fans go dey di stadium in dia numbers to support di Ghana team – coach Stefano Cusin say di role of those fans go dey important.
“When you play in front of thousands of fans, you expect di game to be difficult. Ghana play very well against Mali, dat be di kind of game we dey expect.”
Comoros no fit qualify for di world cup but dem fit cause upset and spoil di Ghana party.
But Stefano Cusin dey proud of di work dem do wit dia team.
“Our first target when I take ova dis team be to qualify for di Afcon wey we qualify to play in Ivory Coast, but for dis world cup, we try our best but tins no happen di way we want.”
“Wey player or coach go tok say dem no like to play for di World Cup? We all wan play but we no go reach di mundial sake of we lose some points at di start of di qualifiers.”
Di Comoros coach say Ghana be team wey suppose qualify for di Afcon easily but somehow dem fail to qualify, but dat no mean say dem be bad team.
“At di time Ghana no qualify for Afcon, because dem no dey good form. For di Afcon qualifiers, if you lose guard, you go drop, sake of di games dey happun ova a short space of time.
Wia dis foto come from, GFA
Wetin we call dis foto, Ghana beat CAR 5-0 to stay top of Group I
Wat go be di tiebreaker if di teams get equal points
If both Ghana and Madagascar get di same points, dem go use oda tins to separate dem.
- Overall goal difference: Di team wey get di best goal difference across all di group matches. As tins stand, Ghana get beta goal difference when you compare wit Madagascar (16 v 8)
- Number of goals scored: Di team wey get di most goals for all di group matches. Ghana again dey lead di table for most goals scored, if you compare wit Comoros, ibi (22 v 16)
- Head-to-head results: If afta goal difference and number of goals scored, di two teams still get di same results, den dem now go analyze results of di two matches between di teams.
- Goal difference in head-to-head matches: Dem go check di best goal difference in di two matches di teams play.
- Number of goals scored in head-to-head matches: Di most goals scored in matches between di two teams wey tie on points.
- Number of away goals scored: Dem go check dis one if di tie be between two teams (Ghana and Madagascar)
- Fair Play ranking: Dis point system dey punish cards – yellow, red, two yellow cards and straight red card.
Yellow card -1 point (minus one point)
Second yellow card/indirect red card – 3 points (-3)
Direct red card – 4 points (-4)
Yellow card wey direct red card follow – 5 points (-5)
Drawing of lots: Dis be di last tin dem go use to separate two or more teams wey tie on points. Africa go present nine teams for di 2026 World Cup. Dem fit create 10th spot for din winner of di African playoffs for di intercontinental playoffs.
Wia dis foto come from, GFA
Wetin we call dis foto, Dis go be di fifth time Ghana go reach di world cup (2006, 2010, 2014, 2022)
Team news and Head-to-head
Ghana and Comoros play each oda at least four times.
Ghana win two times, wey dem lose one and draw di oda.
Apart from friendly wey Nigeria beat Ghana 2-1, di Blackstars dey unbeaten in dia last four games.
But Comoros get only two wins in dia last five games.
Dis be di probable lineup for di two coaches.
Ghana starting XI: Asare, Salisu, Mensah, Djiku, Yirenkyi, Sibo, Partey, Semenyo, Kudus, Issahaku, Ayew.
Comoros starting XI: Pandou, Bakari, Toibibou, M’Dahoma, Boura, Mohamed, Selemani, Youssef, Changama, Said, Maolida.
Dis game go be at 7PM GMT and 8PM WAT or di Accra sports stadium.
Make you join us for live commentary .




