News CA
Uma Ukpai don die at 80: Popular Evangelist of Uma Ukpai Evangelistic Association don die

Wia dis foto come from, Facebook/ Dr Uma Ukpai
13 October 2025, 13:34 WAT
New Informate 34 minutes wey don pass
One popular Nigerian evangelist and di leader of di Uma Ukpai Evangelistic Association, Dr Uma Ukpai don die, im family confam.
Di Ukpai family tok am for inside statement on Monday, wey dem reveal say e don even die since October 6, 2025 at di age of 80.
Dem add say say dem dey grateful for di life and work wey im do ova di course of 60 years add say even as dem dey mourn am dem happy say e don “finish im race and now dey rest for eternal praise”.
Howeva, dem neva tok plans for im burial arrangements, say dat one go come afta.




